My name na erigga
For those wey just enter my school of thought
The things we thought before motivation
We've been on top
But I'm still lost
Lost in my thought
Finding fault
Is it mine? Is it yours?
Funny thought
Before the story drop why don't we take some shots
Warri crisis 1997 enter 1999 really shape my thinking
Lost a lot of my bros and sists in a blinking
Forget the oil for ground, I refine the one for my head
Made money but I'm still lost
Part of my still lost
Toast to the thinking "entitlement go make us rich"
People switch like fake yansh and real yansh
It's hard to tell which is which
Lost in the women and the drinking smoking and hoping
That one day my government go serve me
Dem no tell me before I switch to investing in myself
Empty my savings
1999 for okumagba avenue 9 erieovo
Deepest part of the getto, darkest, everyone know
Africa wake e dey happen
People dey hear the voice now e dey happen
Brezz go blow small small politicians yansh go open show
Fowl dey beat ole fowl, e dey happen
Sleeping sons of jacob wake up, e dey happen
Everyday for the thief but one dey for who catch am, e dey happen
Erigga too good God make dem dash am
With all the things he's been through
Nothing scratch am
When God say na your time na your time
No matter the continent you find yourself or anywhere you dey
Na still your time 'cause na thesame time
But at the same time we dey grind
I know people when tell me say my album go flop
Fast forward them shock to see am they pop
I rather dey on top chart than on top your girl
Money na the only friend we fit rely on well
Na me be that basket way dem de use fetch water
Just to disgrace bucket, stop playing with me
If you dey go through alot my brother go come, stop playing with me
We have all been through there no use sub me, disturb me
Na beggie biggie make you feel say ur brother stingy
Entitlement na disease enter pharmacy
For am to pain I gats talk am for pidgin
Nobody owe you chi chi so brother namaste
2016 I dey cell dey think my life
Dey write for wall I swear I almost mentos
For matter way no concern me, naso them find me
Hand cuff me like arm robber when dey pem tools
That was then I no sure say e fit happen again
I'm wiser now money dey I can't complain
Never to catch falling knife leave them make dem talk
Na ribina una be, we no be God
We no be blood
A king and a slave for it is both our duties to serve others
Ballads of a lost boy
The movement just dey start
Una go soon dey take orders
Abeg
⇡ Less
Administrator
Days Ago
Sorry! The Comment Section Was Recently Disabled So You Wont Be Able To Comment on Erigga's Ballads Of A Lost Boy Track | Song